Sunday, July 7, 2013

SHILDHOOD FRIEND...

I called a shildhood friend who lives in Warri to ask after a common
friend of ours, Osogono,
and asked "if e full ground?"

Shildhood Friend: Shuo! You no aware?

Me: Wetin? Wetin? Osogono don delete?

Shildhood Friend: Abeg clear! Na so person dey quick die? Na fawol?

ME: Oya no vex. Detail me the gist?

Shildhood Friend: Not to hin. No be Sogogbish dey do first-to- die
with one kpomushele for Bendel Estate…

ME: I dey hear.

Shildhood Friend: Not to small thing o. No do no do, na so Sogogbish
preg the babe.

ME: How that one come be new edition?

Shildhood Friend: I go quench the gist if u shook mouth put again o!

ME: No provoke. Dey relate the gist.

Shildhood Friend: Last month na hin yawa gas o! All this while wey
Sogogbish dey comb the babe, our guy no fit decode say
she… The babe… Na second verse for one Rear Admiral anthem!

ME: YAWA!

Shildhood Friend: Na so I dey toilet dey kaka for Sogogbish bink I
just hear Gboaaa!!! 5 naval guys just matching matching the door.
Before I say make I clean kaka… Gbooaaah again!! Them don enter
Sogogbish room.

ME: Where Sogogbish come dey?

Shildhood Friend: Aiiiiiiii, if you see the beat them beat me? Me wey
I no see the babe kpekus… If u see the kpokporing. I for no kuku clean
yansh na… I kaka for body na!

ME: Wia Sogo..?

Shildhood Friend: Sogogbish dislink through ceiling. And I warn am… I
warn am say this Admiral babe wey you dey RETWEET anyhow…

Happy Sunday... #teamuniziksugpress

No comments:

Post a Comment

Comment(s) expressed on this blog belong(s) to the individual(s) making them(it) and it is in no way related to UnizikSugNews or Martin Beck Nworah. For articles or news submission, events coverage, birthdays and adverts on the OFFICIAL S.U.G blog; call 08144322744 OR ziksugnews@gmail.com