Monday, September 23, 2013

POEM: NIAJA DON JAGUDA BY JAUNTY UNACHUKWU

Person go go school; Asuu and FG no go allow am
graduate as at when due.

Person go subscribe or buy megabyte but no go get
Megabite to take browse.

Shebi them say travel by air is very safe? Why for
Naija we dey fear to travel by air?

Person go school finish; common job to take cool
temper person...
no go see.

Police man wey dey safe guard civilians no go get
better money as salary wey go do am to stop am to
take bribe.

Person go put in positivity for him business but the atmosphere just
dey knack am akpako with negativity.

Person go suffer build house finish na that time
Government go remember say them wan plant
flower there come demolish the house.

Person go steal Maggi them go burn am; but person wey dey office dey steal billions just dey laugh dem.

Person go follow pay tithes, contribution and
offering for church so dem go fit build school but when dem build am finish poor man pikin no go fit attend.

Person go dress finish to go serve God; another one go come bomb am for inside God house chai!

Monkey they work; bamboo dey chop; these are but a few Temptations in the Nation.

10 comments:

  1. =))º°˚˚˚°ºнaĦaнaº°˚˚˚°º‎​=)) Nice one for 9ja

    ReplyDelete
  2. Lols irony of like (˘̯˘ ). Nice one
    Kassy

    ReplyDelete
  3. Sista of life! Nice 1 dia jhor . Kriss khalifa

    ReplyDelete
  4. On point.kip it up roomy

    ReplyDelete
  5. Nice work Jaunty. This is a classic and hilarious portrayal of what is happening in our society. Do keep it Up Jaunty

    ReplyDelete
  6. Nice piece, sis. U just "jauntized" it, Onyii.

    ReplyDelete
  7. onyi, na fg turn u to poet? lol... keep it up jay

    ReplyDelete
  8. Tanks Swerries...I love u all.... @mani na so I c am ooo

    ReplyDelete

Comment(s) expressed on this blog belong(s) to the individual(s) making them(it) and it is in no way related to UnizikSugNews or Martin Beck Nworah. For articles or news submission, events coverage, birthdays and adverts on the OFFICIAL S.U.G blog; call 08144322744 OR ziksugnews@gmail.com