hospital since dey prepare to born one fine pikin wey dem dey call
ROYAL BABY, dem talk say na em go be d next King of Britain if em be
boy abi Queen of Britain if em be girl. My pple na since then wey
media men, London pple wit cameramen wey no get work go dey stand for
outside of d hospital wey Prince William and em wife Princess Kate dey
wait make dem born dat pikin. As I dey tell u eh, dem neva see Willy
and Katey since one month now wey dem enter dat hospital, na only
hopital door and walls na em dose cameramen dey snap give us. For 9ja
who get dat kind time...lol... Dem dey talk say she fit born on Sunday
ooo, and dem fit even declare 3-7dayz public holiday bcos say new King
abi Queen of Britain don come. If una see all the baby goodies wey
full front of the hospital eh, u go dey ask if na only one pikin wey
neva come world get am. Make we dey wait na, I no know why dem no born
me put 4 dis kind family wey paparazzi full brekete...hehehe!




No comments:
Post a Comment
Comment(s) expressed on this blog belong(s) to the individual(s) making them(it) and it is in no way related to UnizikSugNews or Martin Beck Nworah. For articles or news submission, events coverage, birthdays and adverts on the OFFICIAL S.U.G blog; call 08144322744 OR ziksugnews@gmail.com